Lade – Adulthood Na Scam (Adultood Anthem) Mp3 download

Upcoming talented musician, Lade, has set the internet on Fire with her new single track titled  “Adulthood Na Scam“.

Listen and download Adulthood Na Scam below

DOWNLOAD MP3

Full Lyrics

Lyrics: Adulthood Na Scam by Lade

Nobody go ask if you don chop
Nobody go send you free money
If you no get na you sabi
Adulthood na scam

Ern ern
I head that you’re looking for Lade
Please don’t judge me
Cause I won’t judge you

As I wake up this morning
Landlord don call me
My paddy don ring my phone
Say wey that thing you promise me
I no say you no go believe
Dem no tell me say na so him Dey be
Abeg take me back to days wey e be days nah just to play and chop

Adulthood na scam
You better get am for your mind
You gat to hustle, make a living 24/7
Nobody go ask if you don chop
Nobody go send you free money
If you no get na you sabi
Adulthood na scam

If you no get nah you sabi
You no fit reason your paddy ooo
But if na dem need you dem go come to you come Dey give you different
Story ooo Story oooo
This is super story ooo
Though the story touch me ooo
But I no fit send you money oooo

If say make I calculate wetin I Dey spend from Monday to Sunday
Dey make we reminisce all those days
Wey money go yapa for my pillow case oo
Now I gats to send the money lo le ooo
Everything wey I want I must pay ooo
Mogbe oooo
I fit to give anything to become a child again

Adulthood na scam
You better get am for your mind
You gat to hustle, make a living 24/7
Nobody go ask if you don chop
Nobody go send you free money
If you no get na you sabi
Adulthood na scam

Adulthood na scam
You better get am for your mind
You gat to hustle, make a living 24/7
Nobody go ask if you don chop
Nobody go send you free money
If you no get na you sabi
Adulthood na scam