Erigga Lyrics

Step into the emotional depth of Erigga‘s music with the official lyrics to Saddest Days. Erigga‘s storytelling prowess shines through in this track, inviting you to delve into the lyrical narrative that encapsulates the raw emotions and experiences he shares.

RELATED: Read ‘Strong Warning’ Lyrics by Erigga

Erigga – Saddest Days Lyrics

Paper boy how far naw
You still dey enter that buggie today
Obo una don come wit all this una saturday party oh
Me I don tire I wan relax oh
But my guy na the DJ there u go perform all those your jams I understand naw
Omo I get school oh I get exam oh but no wahala make we enter e no get how e
Be we go rock am

My saddest days were Saturdays
Awudi with my guys dey observe the place
We dey hustle some babes
We dey hustle some babes
My saddest days were Saturdays
Beer pallor with my guys kuti come we gbese
We dey hustle some babes
We dey hustle some babes

Normal level I dey school dey do bookworm
Class finish na to find one baby pull on
Bring kala if you move wrong
Touch us community don remove gun
Leave all these rappers na mouth dem no get receipt
For all those their war stories, dem just dey find retweet
Their heart dey beat tru shirt when we waka pass
One even piss for trouser as I wan break he teeth
Na mostly on Saturday we dey enter gbege
Or big gbese nsugbo e don burst again
Cos who we send go girl dem don burst he head
Party don scatter I dey come help me hold ma chain
Manager dey beg aboy that on no concern me
Scatter rubber for him back stab he bouncer knees
Run enter area chelle on till the matter die
Before we come out make mouth, you know this matter guy

My saddest days were Saturdays
Awudi with my guys dey observe the place
We dey hustle some babes
We dey hustle some babes
My saddest days were Saturdays
Beer pallor with my guys kuti come we gbese
We dey hustle some babes
We dey hustle some babes

Keep cutlass for the bush path
Incase e burst make I know where I go move pass
Yawa go soon gas
3-1 we no dey fear to reduce crowd
The small jazz when we do na 6ix oclock e dey end
Locate the opt alert my men
Collect all their phone based on fuck up fee
Follow back run vigilante draw pumpi
The last person when try am na gutter nai we see am
E be like film for we eye the way kuti take play am
This no be story when I suppose dey talk for track
Yokuzona I sitdown for una face with facts
Na we dey increase the crime rate then
Okere prison still shock with men
Saturday nite I lost my friend
E still dey pain me I no fit pretend

My saddest days were Saturdays
Awudi with my guys dey observe the place
We dey hustle some babes
We dey hustle some babes
My saddest days were Saturdays
Beer pallor with my guys kuti come we gbese
We dey hustle some babes
We dey hustle some babes

Can’t believe how we dey run am that year menh
Niggas go treekkkkkkkk go find kele when we wan go back we go come dey
Pray make dem no see as as we dey trek go house until we come gather money
Go run one na that car nai put us for problem I swear omo we don really crase
For this wafftown I swear

Check Lyrics of latest Naija songs Here


Meaning of Saddest Days Lyrics by Erigga

Many users have been searching for Saddest Days Lyrics by Erigga because the music has a meaningful lyrics and it worth knowing all the details. The music was released on 2023-10-29 08:17:19.

The lyrics allows you to understand the music very well and to also know how to sing the song. Read the lyrics alongside with the music for better understanding.


Conclusion

This is the end of Saddest Days Lyrics by Erigga. If you discover any mistake in the song lyrics, please send the correct lyrics by using the Contact Us form.

Thanks for checking out Celebnob Lyrics more lyrics here.